HE WHO LAFF LAST LAFF BEST!!!- OBJ VS GEJ

0
Spread the post

OBJ:GEJ,How Market?
GEJ:Baba, Market Bad ooo Everywere nasoso SAI
BUHARI.
OBJ:hahahahahaha
GEJ:Baba, why u dey laff now?
OBJ: Pikin Wey Say ELDERS Na Motor Park Touts,
Na Wetin Him Eyes Dey See Be That Oo
GEJ:Baba No Vex,Na Some Hooligans Around Me
Say Make I Respond Like That.
OBJ:Abi, So Those Hooligans Fit Tell U Say Make U
drink DETTOL And U Go Drink Am?
GEJ:Baba, DETTOL Ke! I No Fit oo
OBJ: OK oo Just Go Dey Do Ur Campaign But Nuttin
For U oo.U Don Right Hand Over Note?
GEJ:Nuttin For Me? Mogbe oo As For HandOver
Note
Tain-Tain I don Write Am oo But E Be Like Say Na
Namadi Go HandOver Me Dey Run Go Jamaica.
OBJ:Hahahahahahah Chei Diaris God oooo
GEJ:Baba,Na D Koko B Dat oo BUHARI Don Mean
me Nobi Small.$20billion saga,Pension palava,AIT
Documentary Dem-Dem.Baba, U Mean Say We No
Fit RIG?
OBJ: Jona!!! Funny Boy, Rigging No Possible This
Time. Naija People Don Over Wise oo ITS TOO
LATE OOO.
GEJ:Hmmm(crying)I Don Enter Oo
OBJ:Yes oo U Don Enter Kiri-Kiri Maximum Prison
Ooo Lol.
GEJ:Baba, Naso I Go Pack Comot Aso-Villa? No
More $4Billion Foods & Some Packages?
OBJ:Naso We Self Missed Those Things oo Na
Small Small U Go Get Use To Akpu & Ogbono Soup
Like B4.Lol
GEJ:hmmmmm Naija People Make Una Learn From
Me ooo
Una See Wetin DISRESPECT & LACKADAISICAL
ATTITUDE 2 Elders Caused Me.(Crying Seriously
Like A Baby).


Spread the post

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here